Hon. Stitches (@Only1stitches) header
Hon. Stitches (@Only1stitches) profile picture

🎤 You Fit Call Me D #GhettoPreacher, Follow Me, I Dey Use Pidgin English Dilute Naija Matter🇳🇬 💬 On Governance, politics & everything wey concern #Nigeria✌

Lagos, Nigeria
Joined November 2024
I was chatting with some youths in my community today about why they should submit their names to INEC for polling unit agents, so that they can be in charge of their community votes. So, na wetin we dey discuss there. ​Naim this my guy enter, wey we dey ADC together before we move to NDC. So na my guy, I made sure say the division didn't divide us. As e enter, he jokingly started with a smile, he say, "guy, I nor go gree for you, this na my people." I ignore am, I dey laugh, him self dey laugh 😆 ​I hail am the way I take dey hail am, "the ADC man." Him go call me the "NDC Man" or "Peter Obi boy" as e oga, wey dem dey call "Mr Timo Jesu." Wey he dey call me, I dey call am "my boss." I respect am a lot, na correct man. The man don tire for my matter 😀 e try vex 🙄 I nor gree 🤣 ​I tell am say, bros, abeg leave this people for me, I don collect dem for the good side. The guy say make he look book, he see names 😆 naim he paro, he change am for one, he say, shey you don already be my polling unit agent? Naim the guy tell am, Peter Obi or nothing bros 😆 But last last, everybody jolly together. ​I say we must be friends, weda we dey same party or not, we be brothers. Na we dey area, na we go still remain for area. Before we see Peter Obi, or anybody wey we say we dey support, we go first see ourselves first for community, the people and leaders first. ​ ​I dey Enjoy am, you can see it in my body and expression, I dey enjoy the acceptance from the people of Ishefun community. The people of this Ishefun Town are good people, and I appreciate them, na why I dey try to bring the government closer to them, and also bring them closer to the government. ​I am motivated by God's grace and the willingness to play a part and be recorded in history just like those we call the past leaders today. They played their part, this is my part, no one paid me and no one can or should pay me to have sense, I should have sense because I am supposed to have sense 😊 ​As day begin dark, naim I carry myself begin go where I dey stay. ​So, make I drop this one for here, for my Obidients family and NDC supporters wey truly the support the course. I greet all of una. I appreciate everyone wey dey like, comment, share, and repost my post. One like ❤ mean a lot to me🙏 it means you appreciate my creativity and message behind the post oryou just want to encourage me, thank you, if I have the right tools I will do better. Please manage the quality of my videos for now, na wetin I get I dey use.🕺✊🏿✌ ​I appreciate you all for what you are and what you stand for. With oneness, I believe a new Nigeria is possible, and we are already taking the step. ​Just be safe, be careful, respect everyone. When you talk to someone and the person seem strong headed or bigoted or one annoying person or the other. Nor worry, e nor go fit bite you🤣 sometimes na IGG (initial gra gra). Just respect am, respect yourself, and you should know the next best line of action to take.
8
30
1
97
10,907
You nor lie at all, that's why we are bringing it to the public, it's now obvious that the case is more than we can handle alone, we need all the well meaning Nigerians to escalate this, it's so sad. @ruffydfire sir abeg don't ignore this, abeg, you need to help us escalate this.
🆘 The Obidient Movement and OK Movement needs to know that ALIMOSHO is APC stronghold o! If u let them successfully bully NDC out of there Jesus! You have opened a door for MASSIVE RIGGING! #PeterObi #NDC #Obi/Kwankwaso
1
2
52
Shey na like this we go dey dey?
1
11
Hon. Stitches retweeted
Trending Video of Peter Obi receiving babies, vegetables, groundnut and fresh fruit gifts in Owerri
7
95
5
400
11,478
Hon. Stitches retweeted
@ruffydfire @OjyOkpe This is the latest update from the Alimosho area, where the NDC office is located. Take a look at what is happening to the opposition under the APC government.
1
1
1
109
Hon. Stitches retweeted
BURIED & FORGOTTEN
9
87
5
203
3,426
The whole truth about the Lagos - Calabar Coastal Highway is that it was a mirage from the onset because it was never intended to reach Calabar ab initio. Let them rename the road now that it's taking a detour to the existing East-West Road. New name: "Lagos - Eko Atlantic Coastal Highway" removing the Calabar.
1
2
85
Dear Young and well-meaning Nigerians, Let this sink in 👇 The @OfficialAPCNg government has pauperized the country while claiming to be empowering the people from food insecurity to cash insecurity etc. The worst is they're not ready to repent instead they are bragging and intimidating to continue the menace come 2027. Let's stop them before they ruin our future kpatakpata.
1
2
32
Hon. Stitches retweeted
They won't dare bring down that building, are they mad. That same building has local government authority on it, it also has lot's of offices there, so on what basis are they giving them a vacate order?
1
1
2
165
Hon. Stitches retweeted
It's quite unfortunate that all @OfficialAPCNg knows how to do is intimidation and oppression as a way to grab power. Exhibiting thuggery behavior all over the place instead of focusing on issue based politicking like civilized people do. One thing they failed to understand is that their intimidation can't be sustained.
1
1
4
214
NIGERIANS MAKE UNA COME O📢📢 NIGERIA DEMOCRATIC CONGRESS (NDC) ALIMOSHO LOCAL GOVERNMENT AREA, LAGOS STATE Date: 31st October, 2026 MAKE WE CLEAR THE MATTER: ATTEMPT TO FORCE NDC ALIMOSHO SECRETARIAT COMOT ILLEGALLY AND USE POLITICAL THREAT TO INTIMIDATE US E don reach time make we let the general public know wetin the ruling party don dey do concerning our LGA Secretariat for the past few months. The whole matter start when dem begin put pressure and threaten the landlady of the building wey our Secretariat dey, for No. 277 Egbeda/Idimu Road, Alimosho LGA, Lagos State. The caretaker of the building don dey disturb us again and again, dey tell us make we remove our banner wey dey front of our office. According to her, some APC people for Alimosho don warn am say if we no remove the banner, dem go come demolish the whole building. This harassment and threat don continue for weeks and months. But yesterday, 30th October 2026, we see how far their dirty politics don reach. Dem show face with one court document wey get plenty questionable and contradictory things inside, claiming say na order to evict our Secretariat from the building. Normally, we for don stand our ground and challenge this illegal action immediately. But after our Legal Adviser advise us, and because we no want make the matter cause wahala or disturb peace, we decide to remain calm and keep proper record of everything wey happen. MAKE THESE THINGS CLEAR TO EVERYBODY: 1. Nigeria Democratic Congress (NDC), Alimosho LGA, na political party wey dey respect and obey the law. Our office for No. 277 Egbeda/Idimu Road dey there legally, everything follow proper arrangement, and we don pay for the place complete. 2. No matter how dem threaten us, intimidate property owners, send thugs or bring questionable court documents, dem no go make us abandon our constitutional right to join together, belong to political party and carry out our lawful activities. 3. This attempt to silence opposition for Alimosho no follow democracy at all. E show say dem wan use fear hold people down, and e raise serious questions about why the ruling party dey react this way as more people dey show interest and accept NDC for Alimosho LGA. 4. We don instruct our lawyers to challenge this so-called eviction notice for court immediately. We go also send official complaints to the Lagos State Commissioner of Police, DSS and National Human Rights Commission. WE DEY THEREFORE CALL ON: a) The good people of Alimosho, Civil Society Organisations and members of the Press make dem pay attention to this kind dangerous development. b) Nigeria Police Force make dem no allow anybody use dem to persecute or disturb people because of their political party or belief. c) Lagos State Government make dem call their party members to order and warn dem to stop this kind behaviour. NDC for Alimosho no dey shake, we remain focused, and our determination to give the people another credible political choice don strong pass before. We no go allow anybody intimidate us. We no go keep quiet. Nobody go silence us. We attach the receipt of payment to this publication so anybody wey wan confirm fit see am. E-SIGN: Hon. Pius Omodaratan Chairman NDC Alimosho LGA Barr. Williams Ejika Legal Adviser NDC Alimosho LGA Comr. Victoria Johnbee Emmanuel Publicity Secretary Cor. Philip Nyakno Luke Publicity (New Media) FOR NDC ALIMOSHO DIRECTORATE OF MEDIA AND PUBLICATIONS.
7
210
5
265
12,561
Hon. Stitches retweeted
46
385
13
1,357
10,251
🇳🇬Peter Obi Go dey Imo State this afternoon 31st October 2026 12pm. If you dey around we need your physical support, we need the crowd, we need the people, we need all the well meaning Nigerians wey dey support Peter Obi to come out. Join the TownHall meeting na we we✊🏿
1
28
I go fight corruption the way dem never fight am before. I go make sure say I fight insecurity, and I go unite the country.✊🏿 His Excellency Mr Peter Obi
5
8
141
PETER OBI: BAYELSA STATE: BIG CONGRATULATIONS TO SENATOR HENRY SERIAKE DICKSON Yesterday, 30th October 2026, I travel from Enugu go Yenagoa, Bayelsa State, to join people wey come celebrate and welcome my dear brother and our Party National Leader, His Excellency, Senator Henry Seriake Dickson, as e return home. As we dey do this, we still continue to meet and talk with our people. As people gather for the big celebration, I remind Bayelsa people say, even though President Bola Ahmed Tinubu don spend more than three years for office, e never see am as something important to spend even one night for Bayelsa State. But e don spend more than 260 days dey travel go different countries outside Nigeria. I assure our plenty supporters and all the people of Bayelsa say, if na me dey lead this country, this kind thing no go happen. I go visit Bayelsa myself, sit down with our people, hear wetin dey worry dem and know how to answer their complaints. For Bayelsa, I promise say we go start work to make all the seaports for Niger Delta better, including the ones wey dey Warri, Port Harcourt and Calabar. We go also start the work wey dem don delay for long to build Ibaka Seaport for Akwa Ibom State. We go build another new seaport for Bayelsa too, so e go make things easier for people wey dey live for riverine areas and help the whole Niger Delta region. I talk am again say we remain committed to bringing Nigerians together as one, make our country safe, fight corruption, and put serious money into hospitals, healthcare and education. We go also work to bring our people comot from poverty make dem fit live better life. Before I comot, I join Senator Seriake Dickson for traditional canoe war game and boat regatta for im hometown, Toru-Orua, inside Sagbama Local Government Area. I congratulate my dear brother, Senator Henry Seriake Dickson, as e don return home successfully. I also appreciate our Party National and State leaders, all party members and the good people of Bayelsa for the way dem organise the event, the warm welcome wey dem give us and the successful celebration. NEW NIGERIA DEY POSSIBLE, AND NIGERIA GO DEY OK! -PO
BAYELSA STATE: WARM CONGRATULATIONS TO SENATOR HENRY SERIAKE DICKSON Yesterday, 30th October 2026, I travelled from Enugu to Yenagoa, Bayelsa State, to attend the homecoming ceremony honouring my dear brother and our Party’s National Leader, His Excellency, Senator Henry Seriake Dickson, while continuing our engagement with the people. During the grand event, I reminded the good people of Bayelsa State that, after more than three years in office, President Bola Ahmed Tinubu has not considered it appropriate to spend even one night in Bayelsa State, despite spending over 260 days abroad. I assured our numerous supporters and the people of Bayelsa State that this will not happen under my leadership. I will visit Bayelsa to hear directly from our people and respond to their concerns. In Bayelsa, I pledged that we would begin efforts to upgrade ports throughout the Niger Delta, including those in Warri, Port Harcourt, and Calabar. We will also begin construction of the long-delayed Ibaka seaport in Akwa Ibom State and establish a new port in Bayelsa State to serve our riverine communities and the broader Niger Delta more effectively. I reaffirmed our commitment to unite and secure the country, fight corruption, and make substantial investments in healthcare and education while lifting our people out of poverty. The visit concluded with my joining Senator Seriake Dickson, for a traditional canoe war game and boat regatta in his hometown of Toru-Orua, Sagbama Local Government Area. I congratulate my dear brother, Senator Henry Seriake Dickson, on his successful return home. I appreciate our party’s national and state leadership, members as well as the good people of Bayelsa for good organisation, warm reception and successful event. A New Nigeria is POssible, and Nigeria will be OK!. -PO
7
256
🇳🇬Nigerians: Why if Person dey beg una for help, una go dey laugh am🤣 but if e d!e tomorrow now, una go dey say, "why e nor talk"? Some of una go dey cry self😭 I dey talk now, abeg una🙇‍♂️ Make una give me, 💯 genuine work, wey go pay me genuine money, e dey hard for here🙆. People dey think say I get money because of the advocay work wey, e be like say I carry for head dem say make I go change my name if not people nor go help me, chai, eeyah. Abeg na passion for better Nigeria I dey, and na passion wey dem born me with, I dey intentional about playing my part through physical and social media, to advocate the best way I can for a better living for all Nigerians and I see Peter Obi as the person wey go fit bring part of that dream to reality, na why I dey support am. I nor dey support am to generate engagement, no, I dey do wetin I dey do 💯 genuinely and also because I dey live the suffer wey we dey talk about for the Nigeria today. Everything wey I dey advocate for. Na wetin I want to work for Nigeria and if e work e go affect me and you. E nor mean say I nor get problems, abeg una na work I dey find, like this e dey red for me. I nor know where I wan see the next 200 Naira from as we speak. Tell me why if you get help you nor go help me?🙏
Replying to @Blake_9BR
GOOD DAY, PLEASE!!!!! Is there any remote or physical job out there for someone like me? Can I get one? First, a special appreciation to @brandon_be78372 for gifting me this X subscription. It helps me write longer and supports my advocacy. Brandon is a great guy. God bless you, brother. PLEASE, I NEED A JOB! I am a professional fashion designer, because I can't get paid enough when I do the fashion work for someone, so I have not been interested in working for no one in that line. That's why I went to use this period to learn how to work remotely. Which I can boldly plead for any of these listed jobs I have been able to self-trained myself through practice and online training over the years. I can work as a Virtual Assistant, Social Media Manager, Email Manager, Calendar Manager or Research Agent. I can also handle travel arrangements and itineraries using Canva, edit videos with CapCut, join sounds perfectly and combine different speeches into one smooth, complete sentence. I am very quick to learn and adapt to new rules and regulations. I am a man of dignity, respect and understanding. I treat people the way I want them to treat me. I don't judge people by what I am told alone; you have to prove who you are through your character. I am still suffering from the one slight mistake I made by trying the wrong side in 2017. I made the mistake of closing down my shop to travel for the wrong reasons. I travelled out wrongly, came back wrongly and lived wrongly for a few years. Now, here I am, trying to get back on my feet. I have had no source of income for the past six years. I live literally by God's grace, and I am not ashamed to put this out here because I need help. I need help from any genuine human being with the good heart and willingness to offer any kind of opportunity. Please, I need it. I will do the work. When people take money to enter bus and go find job, I use that money to get Internet, because looking for jobs online is submitting your application to the world, so I am here because this is the best place to connect. I know I am my own cause, but it is becoming increasingly difficult to live each day. My heart aches because all this is the result of one foolish mistake I made. I am a civic advocate for good governance, a humanitarian and a genuine, honest man who tries to see people from their own point of view. I learnt tailoring because I wanted to create and sew the designs I envisioned in my head. I knew how creative I was, and people don't always understand how I want my sewing to be, so I learn. I was doing it right. Many would have thought I would become one of the biggest fashion designers out there, and they wouldn't have been wrong. Until April 24, 2017, when I FUXKED UP BIG TIME. That's a long story for a whole movie. PLEASE, I JUST WANT AN OPPORTUNITY TO WORK, EARN AN HONEST LIVING AND GET BACK ON MY FEET. If you have any genuine remote or maybe physical job opportunity, please reach out. I will do the work. I live in Lagos Nigeria 🇳🇬 ❤
1
1
53